^ ^ ^ ^ ^
One of those doctors, Stella Immanuel, has her own Youtube channel...link.
There is coverage on the BBC and the Seattle Times websites.
The BBC have really gone to town: Facts you fit no sabi about di malaria drug for coronavirus treatment...plus this link:
Facebook, Periscope and oda social media sites don pull down one viral video of African doctor wey claim say she use hydroxychloroquine, zinc, and antibacterial drug, Zithromax to treat Covid-19 patient for United States of America.
Dem pull am down afta pipo don view di video 14 million times even as US President Donald Trump retweet di Periscope video before dem take am down.
For di video, Dr Stella Immanuel wey be primary health physician for Houston tell tori pipo for news conference for US say she don treat ova 350 patients wey get Covid-19.
According to Dr Immanuel, she say some of her patients na old pipo, some get diabetes, high blood pressure and asthma.
"I give dem hydroxychloroquine, I give dem zinc, I give dem Zithromax and all of dem well " Na wetin Dr Stella tok.
Coronavirus still dey spread across di world, with more than 16 million confirmed cases for 188 countries. Almost 650,000 don die from di disease...